Subscribe Now
Trending News

Blog Post

#EndSARS: Comedian Mr Macaroni Scolds Celebrities For ‘Eating’ Govt Money
News

#EndSARS: Comedian Mr Macaroni Scolds Celebrities For ‘Eating’ Govt Money 

A year after the demonstration, the comedian posted a lengthy Instagram post about how the government has cracked down on events scheduled.

By Omotayo Olutekunbi

Mr. Macaroni, an ace comedian, has chastised celebrities for being benefactors of the government, which he claims suppressed events marking the #EndSARS anniversary.

On Friday, the comedian wrote a lengthy Instagram post about how the government has cracked down on events planned a year after the protest.

The comedian, who was a key figure in last year’s protests, urged young people to band together to improve government.

His statement, which was mostly typed on Pidgin, went like this:  “I wan talk my mind as e dey pain me!! E don reach one year wey EndSars happen. Anytime wey people say dem wan do anything wey relate with Endsars for this Lagos; na so so Police Vans, Trucks, even Armor Tanks wey dem go pack full the place.

“This same Lagos wey dem go dey rob people for broad daylight and nobody will come to your rescue. Now October 20th is almost here.

“We say we wan do peaceful walk to Tollgate, dem say no. Oya make we do Summit for Landmark Event Center, in a controlled environment and discuss with ourselves, some powers above don threaten them.

“Those ones don talk say we no fit hold event there again. And how can anyone blame them honestly? Dem dey protect themselves, dem business and customers.

“My question is, can’t Nigerian Youths gather again to discuss the Way forward? Ok. Na una plan to rule forever be this??

“Lagos State Government has an event this evening. Infact Top Celebrities go dey there to perform.

“Lagos state dey do show days before October 20th but other Lagosians can’t gather for their own peaceful summit?? Before I talk finish now, you go hear ‘they will hijack your summit’.

“So how Una dey do Una own shows and political rallies wey dem no dey Hijack am?

“For the celebrities, make we dey reason this thing. Government no good but una dey chop Government money.

“I no say make anybody no chop. But there are some things bigger than money!! If na Government wey dey treat the people better now, e for even better. People are suffering and these people are doing nothing about it!

“The last time wey police carry me, dem beat me and the others!! They stripped us Naked!! Dem dey ask me say “Sheyb na me wan dey disturb Governor Abi” Shey na that kain Government I go respect?

“If there will be any peaceful walk on the 20th, I’m still down. But it must be all of us together.

“E no go bad if Una go for the Government’s show and still attend a summit or take a walk for the youths. Everybody want Coconut Water but nobody want make dem break the coconut for their head.

“For Nigeria, even if you let them break Coconut on your head, powers above still fit no let the others drink the coconut water. We must all come together!” (sic).

Related posts

Leave a Reply

Required fields are marked *